
De Naija Supa Eagus don carri de 2013 Afcon title afta dem take style bulala Burkina Faso 1-0 for South Africa on Sunday.
Dis na de third time now wey Naija go win de Nations cup for dia history as dem don win for 1980 and 1994.
Na Sunday Mba na him be de messiah again for de Supa Eagus as na de guyman score de onli goal for de 40th minute wey Naija take win de cup.
Sunday Mba don score 2goals for de Supa Eagus for dis competison as dey guyman wey dey tap hin futball for de Naija Lig club wey be Warri Wolves make Naija pipu and fans happi again.
Naija carri dia 1-0 lead enta de sekond half, but Burkina Faso vex come out and e remain small make dem score but Naija goalie wey be Vincent Enyeama dey kampe for post as him pari de shot wey Bance play kommot.
De Supa Eagus kon get anoda oppurtuniti for dem to doubu dia lead wen de time don dey reach as Ahmed Musa carri ball for ground, but Naija strika Brown Ideye no fit score am.
E kon remain two minute make de refiree blow hin final wisu wen de Naija coachi kommot Sunday Mba wey score de winning goal as Naija skippo Joseph Yobo enta replace am.
For de end, de Supa Eagus win de 2013 Afcon and na dem go represent Africa for de June confederation cup for Brazil.
Areme-007.blogspot.com always gives you the latest fashion and beauty trends, tips and news. We are committed to bringing you the best of Black lifestyle and celebrity culture.
You can follow us @Areme
via supersport
No comments:
Post a Comment